Una don see am? One new gist dey run around this week say some plantain chips sellers dey drop pieces of nylon inside hot oil before dem fry plantain. Di reason, according to di gist, na say nylon go make di chips hard, crunchy, and e no go break easily.
Person wey dey enjoy chips with Coke for traffic don start to look im nylon bag with suspicion. 😂
Wetin we sabi so far
As we dey talk so, no agency for Nigeria or Ghana don confirm say sellers dey do am. Video wey dey go viral no mean say na wetin everybody dey do.
For Ghana, wey dem don dey fight dis same rumour for years, di Food and Drugs Authority (FDA) start nationwide investigation for March 2026. Di Deputy CEO, Roderick Daddey-Adjei, later talk say dem never see any evidence.
“The plastic is another type of chemistry, and the oil is edible, they don’t mix,” he talk.
But no relax body yet
Ghana FDA still warn say if anybody dey melt plastic for frying oil, na “direct chemical contamination of food.” Chemicals fit enter wetin you dey chop, and if you chop am for long time, e fit scatter your hormone and increase risk of some cancers.
Dis gist no new o
For January 2024, one video bin don go viral say one woman put about five pieces of nylon inside hot oil before she grate plantain enter am. Lagos State Consumer Protection Agency warn people, and NAFDAC talk say dem go test am for lab. Till today, THF never see any result wey dem publish.
Di verdict: E never prove
How to protect yourself:
- Buy chips wey get NAFDAC number from seller wey you trust
- If chips smell like chemical or taste like plastic, throw am away
- If chips stay hard and no change for many many days, shine your eye
- If you see anybody wey dey do am, report to NAFDAC
Abeg, share facts, no be fear. Plenty plantain chips sellers na small traders wey dey use am feed their family.
The Health Factor Africa
Get verified health news, free
One email a week: explainers, myth-checks, and the stories behind the headlines.



