Una don feel am? Di sun wey dey knock person head these days no be ordinary sun. NiMet don confirm say strong El Niño don start for 2026, and National Emergency Management Agency (NEMA) don shout: “Super El Niño Is Coming!”
NEMA talk say dis weather wahala fit bring heat wey pass normal, small rain, drought, flood and food scarcity. Na why dem drop 8 tins wey every house suppose do:
- Run from 11am to 4pm sun. Stay for shade, wear hat, drink water, and do heavy work for morning or evening
- No waste water. Fix leaking tap, store water inside clean covered container
- Drink water well well. Wear light cloth, and check on pikin, old people and anybody wey weak
- Protect your health. Keep environment clean to block malaria and waterborne disease, and go hospital early if body no correct
- Store food. Keep small emergency food, support home farming, take care of your fowl and goat
- Plan your hustle. Plant crops wey fit stand drought and find extra way to make money
- Follow correct info. Listen to NEMA, NiMet and trusted news, no be WhatsApp uncle
- Carry your neighbour along. Share warning, look after people wey no fit help themselves
Researchers don even project say Nigeria fit see about 31,400 extra heat deaths by February 2027, di highest for di whole world. But most of dem fit dey prevented if we prepare.
Heat no dey announce itself. Shine your eye, drink your water, and check your mama.
The Health Factor Africa
Get verified health news, free
One email a week: explainers, myth-checks, and the stories behind the headlines.



